CRYING IN A LAMBO


Let’s digest this piece with some pidgin English.

Some of the gals dem say they rather be crying in a Bentley than laughing in a Corolla—that type shii.

So, better sad in a Limo than happy in a Camry.

Is that not so?

Oya na—time to cry reach, dem come dey form victim mentality and are shopping for sympathy. 

Remember your words and promise to yourself.

They chose money and largesse over pure solid love, authentic connection and genuine respect.

After all, what is romance without finance.

Bentley and Lamborghini wey dey cheat no dey too pain like Jeta or keke wey go still cheat las las.

Abi no be so.

Person sha fit divorce you and leave you with the car and house as per they know say na those things wey you really marry, no be dem dem like that, abi?

No be lie.

Be careful what you wish for. 

You go cry—inside G wagon. Congrats to you!

Chai, poverty mentality na bastard.

He will give you money and stuffs that you want.

Then he will leave you and your fake love and fake life.

He will go meet a lady who gives him more peace.

More happiness. More respect. More romance.

Shebi you sef don play your game…

You don achieve one or two, anyhow…

As smooth criminal wey you be!

Buh no be only you get sense na, gee.

Collect your money and comot for here. 

As na the money you need, not the person.

Go and cry alone in your gifted fancy car.

Dry your tears with the cash wey you collect.

Leave the person as you no really care about am.

Na so e be.

Comments

Popular posts from this blog

SUPPORT NOT SUPPLANT

THE ETHICAL BEAST

DESTROY THIS TEMPLE